ASUU strike 2022: Academic Staff Union of Universities dey embark on one-month strike

 Matter too much joor:


Di Academic Staff Union of Universities, ASUU don decide to go on strike.

Di strike go start Monday, February 14 wit immediate effect. E go last till March 14, 2022.

Di National President of ASUU, Prof Emmanuel Osodoke wey disclose dis to tori pipo afta di two-day National Executive meeting say di union go embark on one month warning strike to give goment time to chook eye for dia demand.

ASUU and goment don dey gbege on top major issues wey centre around universities revitalization moni, earned allowance, Integrated Payroll and Personnel Information System (IPPIS) payment platform and payment of witheld salaries.

Prof. Osodoke say despite say dem develop dia own payment system UTAS, wey dey very effective, goment dey still push di IPPIS system down dia throat and e dey affect dia members.

Dis tori dey come afta di weekend marathon meeting wey ASUU National Executive Council, NEC, do for Lagos, south west Nigeria.

Di meeting wey start on Saturday, February 12, bin end in di early hours of February 14, 2022.

Di union dey para wit Nigerian goment sake of say dem no fulfil some of di agreements dem make wit dem as far back as 2009.


National Association of Nigerian Students accuse ASUU/Goment say 'dem dey toil wit our future'

Di president of di National Association of Nigerian Students, say both di federal goment and ASUU no dey dey fair to Nigerian students.

Sunday Adedayo tell BBC Pidgin say, di one month warning strike go definitely affect di Nigerian education sector and di future of mani students.

E explain say even though di student union understand say wetin ASUU dey fight for na for di interest of public universities for di kontri, but di frequency of di strike don too much.

Adedayo also say di federal goment no dey sincere wen e come to keeping to dia agreement and as e be now, na Nigerian students dey at di receiving end of di fight-fight between ASUU and di goment.

Adedayo also say di last eight to nine month strike wey end for 2020 bin spoil mani students plan, some no fit go NYSC, odas no graduate early, those wey get business for campus wey dem dey take train demsefs, di business dem dabaru sake of di strike.

E say di student bodi bin no wan joinbodi for di strike mata but as e be now, dem no get option dan to take di necessary action.

Some parents wey speak to BBC Pidgin, say di continuous strike dey affect dia pikin dem as "an idle man be devil workshop."

Paulina Ikwuje say na pikin of poor pipo dem dey go public school and na dem dey face di music. She explain say some of di lecturers and politicians dem, dia pikin dey school abroad and na wetin make dem no dey bothered.

ASUU in meeting wit goment

WIA DIS FOTO COME FROM,FESTUS KEYAMO/TWITTER

Wetin we call dis foto,

ASUU in meeting wit goment

EMMYBLOG:metting things😱

Di last time ASUU do national strike na for March 2020 - E last for last eight months. Dii strike end for December 2020 wen dem sign Memorandum of Action wit goment.

For December, 2021 di federal goment say dem pay N30 billion Revitalisation Fund and N22.5 billion Earned Academic Allowance to lecturers.

"Accountant General Office and the Funds Office of di federal Ministry of Finance tell me say dem don pay di money to di 38 federal universities and all di affected universities go don get dia money," Oga Chris Ngige, di Minister of Labour and Employment bin tok.

But di president of ASUU say goment neva still implement agreements dem reach wit di union.

E say, "nothing positive don hapun since goment and ASUU sign di MoE. Dem don go sleep."

ASUU for November 15, 2021, give di federal goment a three-week ultimatum to shaperly meet dia demand or else dem go strike but dem say no positive response come from goment.

Di lecturers come vex say dem go must go anoda strike sake of say goment no dey straight wen dem agree to something - Dem no dey keep dia own side of di bargain especially regarding di MOU wey dem sign wey lead to di suspension of di 8 month strike for 2020.

Afta di union hold National Executive Council meeting for University of Abuja on November 13 and 14, ASUU President, Prof. Emmanuel Osodeke, say despite say dem hold series of meeting wit Minister of Labour and Employment, Dr. Chris Ngige, on October 14, 2021, on issues, including funding for revitalisation of public universities, earned academic allowances, University Transparency Accountability Solution; promotion arrears, renegotiation of 2009 ASUU-FGN Agreement, and di inconsistencies in Integrated Payroll and Personnel Information System Payment, no beta don show.

Dis one come make di union begin mobilise dia members for strike but afta two days of deliberation, dem decide say dem go do warning strike first and afta dat, if goment do do anytin, dem go den go on indefinite strike.

Lecturers and students carry placards dey protest strike for Universities

WIA DIS FOTO COME FROM,GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto,

           

Comments

Popular posts from this blog

Interesting Facts – All About Agriculture

Postharvest Technology Businesses for MSMEs across sub-Saharan Africa

Problems in Agriculture: Loss of Land and Decreased Varieties